China dey offer parents $1,500 to encourage dem to born more children
                    
Dem dey offer parents in China 3,600 yuan (£375; $500) a year for each of dia children under di age of three in di goment first nationwide subsidy wey aim to boost birth rates.
Di kontri birth rate son dey fall, even afta di ruling Communist Party bin abolish di controversial one-child policy almost a decade ago.
Di handouts go help around 20 million families wit di cost of raising children, according to state media.
Several provinces across China get piloted some form of pay outs to encourage pipo to have more children as di world second largest economy face a looming demographic crisis.
Di scheme, wey dem announce on Monday, dey offer parents a total of up to 10,800 yuan per child.
Di policy dey applied retroactively from di start of dis year, Beijing state broadcaste                
                
            








