
Dem dey offer parents in China 3,600 yuan (£375; $500) a year for each of dia children under di age of three in di goment first nationwide subsidy wey aim to boost birth rates.
Di kontri birth rate son dey fall, even afta di ruling Communist Party bin abolish di controversial one-child policy almost a decade ago.
Di handouts go help around 20 million families wit di cost of raising children, according to state media.
Several provinces across China get piloted some form of pay outs to encourage pipo to have more children as di world second largest economy face a looming demographic crisis.
Di scheme, wey dem announce on Monday, dey offer parents a total of up to 10,800 yuan per child.
Di policy dey applied retroactively from di start of dis year, Beijing state broadcaster CCTV tok.
Families wit children wey dem born between 2022 and 2024 fit also apply for partial subsidies.
Di move follow efforts by local goments to boost birth rates in China.
In March, Hohhot – a city in di northern region of China – begin offer residents up to 100,000 yuan per baby for couples wit at least three children.
Shenyang, a city northeast of Beijing, dey offer 500 yuan a month to local families wit a third child under three.
Last week, Beijing dey also urged local goments to draft plans to implement free preschool education.
Di kontri dey among di world most expensive places to have children, in relative terms, according to a study by China-based YuWa Population Research Institute.
To raise a child to di age of 17 in China dey cost an average of $75,700, di study find.
In January, official figures show say China population bin fall for a third year in a row in 2024.
China bin record 9.54 million babies born in 2024, according to di National Bureau of Statistics.
Dat mark a slight increase from di year bifor but di kontri overall population continue to shrink.
Di kontri 1.4 billion population also dey age fast, add to Beijing demographic concerns.